Close

NA THEM TALK by Ikenna Okeh

Them talk say ‘life na jeje’ But na them make me feel like say I be lazy man Them tell us say ‘united we stand’ But them come talk say ‘every aboki get him own kettle’ Them talk say things go better But all the story wey my papa dey tell me fit sweet pass the one my children go hear Oya, day done break But see where I dey I siddon dey look I never chop since morning But them talk say make I chill Them talk say ground go level Them talk say anything wey hot go cold That one fit be true sha, After all, fuel subsidy matter later cool down Na them talk say anything wey go up go come down

But na which day wey dollar go come down so that my Oga no go give me excuse again?

About The Poet
Ikenna Okeh is a trained Food Scientist. He teaches Biology and writes poetry, short stories and prose in the area of crime fiction. You can find Ikenna Okeh’s short stories on his personal blog. You can also download the ebook version of his book, The Chronicles of Romeo on Kobo.
Ikenna writes from Port-Harcourt, Nigeria.

  • TAGS
  • Ikenna Okeh
  • NA THEM TALK by Ikenna Okeh
  • Poem
  • Poetry
scroll to top